Wia dis foto come from, Instagram
Police probe report on Abba Kyari alleged bribe from Hushpuppi don dey ready and submitted.
Nigeria police oga bin set up Special Investigation Panel to investigate Kyari activities as head of di Police Intelligence Response Team.
Federal Bureau of Investigation [FBI] accuse Kyari of allegedly collecting bribe from Nigeria social media influencer Hushpuppi.
Ramon Olorunwa Abbas, commonly known as Hushpuppi, Hush or Ray dey face fraud charges for US wit jail time.
Inspector-General of Police [IGP] promise justice for all wen e receive di panel on report Abba Kyari on Thursday.
IGP Usman Alkali Baba receive di report on di 26th August, 2021 from di NPF Special Investigation Panel [SIP].
Since 2nd August, 2021 di SIP bin dey investigate di alleged indictment of Abba Kyari by FBI.
Sake of dis mata dem IGP Alkali Baba sack oga Kyari as di head of Nigeria Police Intelligence Response Team.
Di chairman of di panel, DIG Joseph Egbunike, na im submit for Force Headquarters, Abuja.
Wia dis foto come from, Police HQ
IGP Usman Alkali Baba receive di report on di 26th August, 2021 from di NPF Special Investigation Panel [SIP].
Chairman of di SIP, DIG Joseph Egbunike, reveal say di report contain di case file of di probe.
Evidences, findings and testimonies from DCP Abba Kyari plus oda pesins and groups linked to Hushpuppi mata dey di report.
As e dey present di report, oga Egbunike say;
E appreciate di IGP for di confidence wey e get on am and di members of di Panel to conduct di probe.
DIG Egbunike say di panel begin dia investigation immediately dey set dem up on 2nd August, 2021.
And di report wey dem submit na outcome of dia hard work. im add..
Wia dis foto come from, NPF
IGP Usman Alkali Baba
Oga for police, Usman Alkali Baba praise di Panel for dia work and say;
Di reason for di probe na to carry out discrete investigations into di allegation against Abba Kyari.
E say dis investigation report go guide di leadership of di Force leadership for dia decision-making processes.
Di IGP promise say di Force Management Team go carefully and quick -quick review di recommendations for di report.
And later forward am to appropriate quarters for necessary actions, di IGP add.
E also promise justice for all.
© 2021 BBC. De external site no concern BBC. De way wey we de take go external link.