Jos killings today: Plateau state governor Simon Lalong impose 24-hour curfew for Jos North – BBC News

Wia dis foto come from, Getty Images
Nigeria Police and some local security pipo for Nigeria
Plateau State govnor Simon Lalong don impose 24-hours curfew for Jos north local goment area as dem say e dey necessary to avoid further breakdown of di security situation for di area.
Di state goment say di curfew go also include; Jos south and Bassa but di one for Jos north go take effect from 2pm on Sunday.
Di state goment say na 23 travellers die and many odas wunjure afta armed men attack dia bus for di central city of Jos.
Nigeria Presidency condemn di attack on travellers along Rukuba road for Jos North Local Government Area of Plateau state on Saturday morning.
Di president office call di attack wicked, dem don order security agencies to arrest di pipo wey dey behind di attack.
"Dis kind of attacks on our kontri citizens dey unacceptable, heinous, and stand in complete contradiction to di teachings of di great religions of our nation," di presidency tok inside statement.
Tori be say di victims na muslims wey dey travel wit convoy of buses to southern Nigeria from di northern city of Bauchi wia dem bin go attend one religious ceremony to mark di Muslim new year.
Di mob ambush and smash dia bus as di pipo dey travel through di city, na so police tok.
Di authorities also confirm say dem don arrest some pipo.
Wia dis foto come from, Getty Images
View of Jos city for North central Nigeria
For di statement wey presidential tok-tok pesin, Garba Shehu sign, di presidency claim say di attack dey "planned".
"With di evident preparedness of their attackers, e dey clear say dis na well-conceived and prearranged assault on a known target, location and religious persuasion of di travellers no be opportunist ambush."
According to police tok-tok pesin for Plateau, Gabriel Ogaba: "On 14th August, 2021 at about 09:28 hours, di Plateau State Police Command receive distress call say group of attackers suspected to be Irigwe youths and dia sympathisers along Rukuba Road of Jos North LGA attack one convoy of five buses wit Muslim faithful wey dey come back from di Annual Zikr prayer for Bauchi State on dia way to Ikare for Ondo State.
"Unfortunately, na 22 persons and Fourteen wunjure for di attack."
"Di Commissioner of Police, Plateau State Command, CP Edward Egbuka, along wit di GOC 3-Division, Major General Ibrahim Ali, don visit di scene."
But one local journalist wey visit Plateau State Specialist Hospital tell BBC say im count thirty deadi bodi and many wounded victims wey dem dey treat.
Most of di victims get machete cuts according to witnesses.
E never clear why di mob attack di travellers but di state of Plateau don experience herder-farmer clashes before before even though e don reduce.
Wia dis foto come from, Getty Images
Lalong say e goment no go tolerate ''any form of lawlessness''
Plateau state govnor Simon Lalong don condem di latest killings as im say goment no go tolerate ''any form of lawlessness.''
Di latest incident happen just days afta deadly communal clash for di area – between Fulani herders wey be mainly Muslim and farmers from the Iregwe ethnic group wey be mainly Christian.
Di north-central state don see more dan ten years of deadly communal violence since 2001 before di conflict reduce in recent years.
But di one na di deadliest violence for di state capital in several years and e dey happen as insecurity across Nigeria dey worse.
© 2021 BBC. De external site no concern BBC. De way wey we de take go external link.

source