June 12 Protests: Lagos, Abuja protesters face police tear gas as dem demonstrate – See how e happun for oda states – BBC News

Protester for Lagos stand in di middle of smoke from police tear gas
Nigerian police don use teargas to pursue June 12 protesters for Lagos and Abuja.
Some of di protesters bin carry placards and dey sing anti-Buhari songs for Abuja.
Despite say police and some state goments bin don warn against protests for di kontri sake of how di End Sars own take end, e no stop some pipo from entering di streets to protest.
One of di protesters for Lagos state tell BBC Pidgin say police bin arrest dem and rough handle dem but later release dem.
"I come out for dis kontri to be a better kontri. We don tire, we don tire for oppression and killing we want a better Nigeria.
We no do anything, na peaceful protest but suddenly dem come start to dey shoot teargas and before we know am dem start to dey chase us up and dan. Dem pick me up and start to dey beat me and take me go black maria but suddenly dem just say make we go." E tok.
From wetin we observe from across di states, di protesters be mostly youths.
Some of di protesters for Abuja carry placards wey get "Buhari Must Go" sign.
Dis wan na even as some pro-Buhari pipo too gada for Unity Ground to counter dem.
Most of di rest of dem wey spread across di kontri say dem come out to protest against bad governance, leadership and insecurity.
Nigeria main opposition party, di Peoples democratic party don condemn di way police take stop wetin dem describe as "peaceful protesters" on Democracy day.
For statement PDP tok-tok pesin Kola Ologbondiyan call goment actions on Nigerian citizens ungodly.
Dem say e "dey awkward say APC and President Buhari, wey bin get freedom to protest for 2014, go turn around to subject Nigerians to actions wey dey against inhumanity including di use of firearms against di pipo, as we witness today".
Protests dey go on for oda parts of di kontri too. Our tori pipo observe say aside from di protest for Abuja and Lagos, some odas South West states follow for di mata.
Police dey shoot teargas for Ojota, Lagos wia pipo bin gada to protest
Kwara
Our tori pesin wey monitor wetin happun for dia say im no see any sign of protesters although e sight security officials for strategic places.
Flash points around Ilorin Metropolis like two student areas of Tanke (University of Ilorin) and Eleko (Kwara State Polytechnic) dey empty of protest.
For Abeokuta protest no hold but MKO Abiola family do small programme to mark di day
Ogun
For Abeokuta, di capital of Ogun state and home to di late Moshood Kashimawo Olawale (MKO) Abiola, everywhere dey cool and calm.
Di protest wey most pipo dey fear say go happun never happun as at di time of dis report.
Heavy security presence dey almost every junction for egba here.
Di favourite protest grounds like Panseke and (Ori omi, oke sokori) dey empty.
Although no market dey opened, and some commercial activities dey grounded becos of di fear of the planned protest wey never show face.
Meanwhile, for di family house of MKO Abiola dem dey organise paryer in honour of the late sage, members of im family gada with oda egba Chiefs to honour am in prayers, security operatives from the Nigeria Army, Nigeria police, Department of State security, NSCDC and Amotekun corps also dey strategic locations.
Ondo
Organisers of di protest bin announce say dem go gada by 7 am for di Post Office for Akure, but di entire protest ground and area empty at di time BBC Pidgin land dia as early as 6:50amNa around 7:30am, some youth begin gada and di protest start at exactly 7:45 and di crowd continue to grow till like 8:30am wen di number increase and e take full swing.
Meanwhile, roads empty, streets, markets, motor parks and offices dey under lock and key as pipo fear to come out sake of tori wey bin don dey fly upandan about di protest.
Hours before di protest begin, messages circulate for WhatsApp and social media platforms say make pipo warn dia children to stay safe and out of di protest
On Friday, di Deji of Akure, Oba Aladetoyinbo Aladelusi bin tok to some youth leaders for Akure not to protest.
Police bin also release statement to assure pipo to go about dia daily activities without any fear.
But di protest haun and most of di protesters na young pipo.
Di protesters wey say dem dey protest against insecurity, bad governance and leadership march from Post Office to Oja Oba, S.O junction, Ondo State Judiciary Headquarters, NEPA round about before dem move go Arakale street.
Osun
Na as early as 7:00am in di morning protesters begin to gada for Okefia roundabout near Government house, Osogbo.
Combined security operatives bin also dey on ground to maintain law and order.
Security personnel bin also tanda for strategic places across di city just as patrol vehicles bin dey move around different locations.
Di protesters wey include members of civil society organisations and student unions say June 12 dey significant for di life of di nation democratic governance and na avenue to wake up di government to dia responsibility.
Di peaceful protesters lead procession with placards from Okefia roundabout, through Alekuwodo area to Olaiya roundabouts and back to wia dem start from before dem end.
Oyo
Protest for Oyo state kick off around 9:27 am for Mokola roundabout.
Some of di protesters wey tok to BBC Pidgin condemn di increase cases of banditry, kidnappings, corruption and other forms of social injustice and di way goment dey handle di mata.
Di protesters wey dey relatively peaceful round-off around 4:00pm.
© 2021 BBC. De external site no concern BBC. De way wey we de take go external link.

source